Naija Music - Naija - NaijaVibe Music - Naija Vibe - Nigeria Music - Naija Vibe - Naija Vibe - NaijaVibe Music Download -

LYRIC

NaijaVibe

2Baba & Falz - Rise Up

2Baba & Falz – Rise Up AuDio

2Baba & Falz – Rise Up Lyrics

Intro
Eh eh Ladies and gentlemen
Introducing
Extra special 2baba
And honourable Falz the bahd guy
(Bahd guyz is in the building yea)
Oow ooh yea yea, woh woh woh woh yea yea
Honorable, eih eih mmm

Pre-Chorus: 2baba
As gbege dey happen around the world
And the news wey full for air
Dey make liver dey fail you
Dey make spirit dey dampen
Omo guy, na your eyes you go sharpen (honourable)
You need to take care of yourself
Cause the curve go flatten
Better go dey start to dey happen

Chorus: 2baba
Know say gbege go come and go, ebelebe
We suppose to jump am o, ebelebe
We suppose to know say, we must to rise up again o
Eh, Gbege must come and go, ebelebe
We suppose to jump am o, ebelebe
We suppose to know say, We go rise up again o

Verse 1 – Falz
(Bahd guyz is in the building)
Yawa dey today, but hey morrow go better
Gbege wey dey now e no go kill us never
I collect 1 Trophy make I take forget am (you say?)
2 bottles with 2baba we dey for gether (a guy)
Make I keep am short mi o fe soro ju
Everybody know say all my people dey colorful (fresh)
When the gbege jam us for body we lost 1 or 2
And the matter hook us for neck we no no what to do (honorable)
Stop there turn round you go see action (common)
Where man fall down he go still rise up (straight up)
Wetin no kill man na wetin make he sharp (that’s right)
And you no fit die for film na you be actor (you’re the actor)
You go wide the chest like you be man o war (eh)
You go wipe the death like you be janitor (yea)
You recharge energy and start afresh
Wether you dey Budapest, Lagos city Marrakesh

Pre-Chorus: 2baba
As gbege dey happen around the world
And the news wey full for air
Dey make liver dey fail you
Dey make spirit dey dampen
Omo guy, na your eyes you go sharpen (omo guy na your eye go sharpen)
You need to take care of yourself
Cause the curve go flatten
Better go dey start to dey happen

Chorus: 2baba
Know say gbege go come and go, ebelebe
We suppose to jump am o, ebelebe
We suppose to know say, we must to rise up again o (extra special, extra special)
Eh, Gbege must come and go, ebelebe
We suppose to jump am o, ebelebe
We suppose to know say, We go rise up again o

Verse 2 – Falz (2baba)
(Ah the thing wan just..)
The pepper go still rest e go still rest, ceteris paribus
Better go still dey wey the flexing go dey unanimous (opor walahi)
All my people turn up, turn up to the maximum (turn up o)
Bad water wey dey flow come no go fit carry us (never ever)
As I dey talk sho n gbo, sho n gbami gbo
All the quanter wey you think say ko le pari mo (for where)
So fun Tolani, Chidera pelu Amina
Pe adura wa to gba e ma shey Amin mo (eh-eh)

To the heroes we lost we no go forget (never ever)
Heaven prepare the medal wey dem go collect (extra special)
Our black panther don unite with black mamba
When the time come we go still jam for Wakanda (we dey come o)
When you get up help us hala captain Chika (say hello o)
And God bless the souls of Uwa and Tina
We stand tough but no matter how e rough bad water wey dey flow gan e no fit carry us

Pre-Chorus: 2baba
As gbege dey happen around the world
And the news wey full for air
Dey make liver dey fail you (chai)
Dey make spirit dey dampen
Omo guy, na your eyes you go sharpen (sharpen your eye, my guy, walahi)
You need to take care of yourself
Cause the curve go flatten
Better go dey start to dey happen

Chorus: 2baba
Know say gbege go come and go, but ebelebe
We suppose to jump am o, ebelebe
We suppose to know say, we must to rise up again o (honorable)
Eh, Gbege must come and go, ebelebe
We suppose to jump am o, ebelebe
We suppose to know say, We go rise up again o

Bridge: 2Baba
Ah The thing just wan test every man
The same thing happen inna every land (walahi)
E no be competition
This one no concern politician eh
The thing just wan test every man
The same thing happen for every land o
This no be competition
This one no concern politi..

Pre-Chorus: 2baba
As gbege dey happen around the world
And the news wey full for air
Dey make liver dey fail you (eh)
Dey make spirit dey dampen
Omo guy, na your eyes you go sharpen (you need to sharpen your eyes o)
You need to take care of yourself
Cause the curve go flatten
Better go dey start to dey happen

Chorus: 2baba
Know say gbege go come and go, ebelebe
We suppose to jump am o, ebelebe
We suppose to know say, we must to rise up again o
Eh, Gbege must come and go, ebelebe
We suppose to jump am o, ebelebe
We suppose to know say, We go rise up again o

Outro
A guy!
Chu Falz,
Gentlemen
Honorable,
Extra Special
Oowww


Added by

StiphBami

SHARE

Your email address will not be published. Required fields are marked *

NaijaVibe